UNIPORT expel prime suspect for di alleged brutal murder of Justina 'Tiffany' Otuene

Di management of University of Port Harcourt say dem no go rest until late Justina Otuene get justice.

Dean of Student Affairs Uniport, Chima Wokocha tok dis one wen im and di Vice Chancellor, Prof Owunari Georgewill bin go visit di Police station wia police bin hold di prime suspect for di alleged murder.


Wokocha say di University dey embarrassed by wetin don happen and dem go support evri effort to bring justice for di mata.


“I wan to assure una say di University no go try to stop di process of di law and di University also dey worried about dia image with dis kain incident,” di Dean tok.

Di horrifying death of one undergraduate student Justina Otuene Nkang wey pipo sabi as 'Tiffany’ dey attract serious vex.

Tiffany na 300level student of di University of Port Harcourt for Rivers state, South south Nigeria.

Tori be say na di estate security for one neighbourhood for NTA Road Mgbuoba, Port Harcourt discover di body of one young girl.

Dem catch 25-year-old man wey dem say na her boyfriend wen e dey try move di deadi body comot – dem alert police wey arrest am.

Di suspect na also student of di University of Port Harcourt.


Videos wey dey circulate on social media show how di said boyfriend in handcuffs lead police officers go im house.

Di Vice Chancellor insist say “justice must be done for di mata becos no student here get di right to kill or get physical with anybody. E dey wrong and di punishment for fighting or getting physical with anybody na outright expulsion.”

Di Dean of Student Affairs add say di university also through di Vice Chancellor don tell di Police to do evritin possible to unravel di mystery wey surround di death of dis very promising young lady.

For di house wey be like studio apartment – di man carry di investigators enta one room wia wheelbarrow dey inside.

Wetin dey on top di wheelbarrow full sack wey dem wrap well-well wit blood stains.

For di video, pesin fit also see plenty stream of blood for ground.

Pipo still dey wan sabi di true identity of di man wey commit di crime.

Many social media users wey don see di tori dey claim say di suspect slaughter Tiffany – say e cut different parts of her body comot.

In di meantime, di Rivers state police command don schedule tok-tok wit tori pipo to reveal wetin happun

Suspect for di death Of Taiffany Otuene


Though di suspect agree say di victim na im girlfriend and dem find her deadibodi for im house, e deny say na im kill her as e say wen e come back house e find her dead.

But e no fit explain why some parts of her bodi dey miss and why e no call police wen e discover say she don die.

According to di boyfriend, e bin meet Justina lifeless body inside im apartment but e no report to any authority.

E say na only im dey stay di apartment.

Di suspect den claim say di reason why e no report to authorities say im girlfriend die na becos im bin dey sick.

Meanwhile e bin stay inside di apartment wit di dead bodi despite di bad odour wey dey comot from dia, e add.

Police authorities for Rivers State arrest di prime suspect, a 24 year old Chemical Engineering student of Uniport wey be di boyfriend of di victim.

Di case dey transferred to di State Criminal Investigations Department to chook eye for di mata before dem charge am to court.

Commissioner of Police Rivers State,


 Polycarp Nwonyi say dem don deposit di deadi body of di victim wey di suspect cut to pieces for mortuary for autopsy as dem suspect say di dismemberment na for ritual purposes.

Rivers State Commissioner of Police Polycarp Nwonyi as e confam di killing of 20-year-old Justina Otuene Nkang say na around 2pm on Wednesday 25 October 2023 pesin from di neighbourhood come report for Ozuoba police station say dem dey perceive very bad odour wey dey come out of di house of di suspect and so di DPO mobilise police officers go di house.

"Di police detectives forcefully open di door and dem discover a Ghana-must-go bag wey contain a lifeless bodi inside. Dem come arrest di boyfriend of di victim wey bin try to run away,” di CP tok.

CP Nwonyi say di prime suspect for di murder na di boyfriend of di victim wey be 24 year old student of chemical engineering for Uniport and e just move into di compound just over a week before di incident happen.

Estate Security discover Justina Otuene Nkang dismembered bodi for her boyfriend house


"Justina Otuene Nkang na di only daughter and fourth pikin of her family," na so her Uncle, John Otuene tell BBC Pidgin.

E say her papa die for 2019 and her mama dey struggle to bring up she and her siblings and she and her brother be students for Uniport.

John say na on Friday dem notice say she no return from wia she dey do internship and so dem try to call her but dem no get her.

Later dem go do missing report for police and on Wednesday 25 October na im police inform dem say dem don discover her deadi body for her boyfriend house for NTA Road Mgbuoba Port Harcourt.


"We dey very sad and unhappy to discover say she don die and we want justice for di mata. We want di police to make sure say dem no sweep dis matter under di carpet as we dey hear for oda similar cases. Na justice we want for our daughter." Na so John Otuene tok.

E describe Justina as a peaceful and jovial pikin wey get plenti promise and high expectations and dia heart dey break as she die like dat.

Brother of Justina Otuene, Osat Otuene add say dem know di boyfriend of dia sister as dem bin don see im picture for her phone before do dem easily recognise am wen di police show am to dem as her boyfriend.

But dem no expect say e go [allegedly] kill her or dem go find her deadibodi for im house.

E say dem just inform dia mama of di latest development and she dey devastated but dem put hope for God say dem go get justice for dia sister.

[Your comment highly recommended on this issue below 👇]

Comments

Popular posts from this blog

Unbelievable underwater City of Heracleion, Egypt, and its Links to Ancient Greece

Otukpo: “Surprising Thing is Robbers are Natives”, Monye Says After ‘Meeting’ With Benue Police PRO Read more:

Gaza show's Israeli soldiers detaining dozens of men stripped to underwear