UNIPORT expel prime suspect for di alleged brutal murder of Justina 'Tiffany' Otuene
26 October 2023 New Informate 5 hours wey don pass Di management of University of Port Harcourt say dem no go rest until late Justina Otuene get justice. Dean of Student Affairs Uniport, Chima Wokocha tok dis one wen im and di Vice Chancellor, Prof Owunari Georgewill bin go visit di Police station wia police bin hold di prime suspect for di alleged murder. Wokocha say di University dey embarrassed by wetin don happen and dem go support evri effort to bring justice for di mata. “I wan to assure una say di University no go try to stop di process of di law and di University also dey worried about dia image with dis kain incident,” di Dean tok. Di horrifying death of one undergraduate student Justina Otuene Nkang wey pipo sabi as 'Tiffany’ dey attract serious vex. Tiffany na 300level student of di University of Port Harcourt for Rivers state, South south Nigeria. Tori be say na di estate security for one neighbourhood for NTA Road Mgbuoba...